One Rivers State High Court for Port Harcourt don convict and sentence a former student of di University of Port Harcourt (Uniport) to death by hanging for di murder of im girlfriend.
Justice Chinwe Nsirim-Nwosu as she deliver judgement on di mata hold say di prosecution prove beyond reasonable doubt say Damian Okoligwe murder Justina Otuene, wey also be student of Biochemistry of di same University, Uniport, dat time.
Na for October 2023 di incident happun afta estate security for one estate for Mgbuoba area discova di body of di young girl.
During di trial, di court hear say Damian Okoligwe wey bin dey study Petrochemical Engineering, commit di crime for im apartment for Mgbuoba community, for Obio-Akpor Local govment Area.
Di prosecution share details of how Okoligwe murder di female student, come divide her body into parts, wey im pack inside wheelbarrow, bifor dem catch am as e try to go troway di bodi for one refuse dumpsite.
Wen di mata happun dat time for 2023, di management of Uniport say dem no go rest until late Justina Otuene get justice.
Di Dean of Student Affairs Uniport dat time, Chima Wokocha and di Vice Chancellor dat time, Prof Owunari Georgewill bin visit di Police station wia police bin hold di prime suspect for di alleged murder.
Di University say dem dey embarrassed by wetin happun and dem go support evri effort to bring justice for di mata.
Na dat suspect wey police bin gbab dat time, wey be di deceased boyfriend, court bin convict and sentence now.
